SR Logo
Facebook Twitter instagram
DJ Mix Free-Beats Biography Lyrics
📚 Story Time    🎧 Artiste Career    📸 Movie Zone

Promote Your Music Today 

|

CATEGORY-: Story Time
[Story] Snake Ladies – An Enchanting Story (Season 2 ~ Episode 2)
Posted Byverified On  October 1st, 2021 Story Time 0 1192 Views
Share On Social Media

Snake Ladies

We got to the eatery and ordered for food.

Me: *signaling a waitress* what would you like to eat.

Mama T: anything my dear Idris is going to eat.

Me: ok, bring two plates of rice with chickens and soft drinks.

Waitress: ok, be right back in a minute.

As the waitress left the place, my phone rang immediately.

Me: ah ah, who could be this one na.. I said looking at my phone. It was Ayo that was calling me..

Me: my guy, my guy. E be like say party dey somewhere oh this one where you remember me so.

Ayo: na wa for you too o. Why anytime wey i call you you must remind me of me not calling and checking on you.

Me: na true na.

The waitress came and dropped the food while i was busy looking at those fresh boobs.

Me: na when be the last time wey you call me.

Ayo: abeg i no dey for this rubbish. I just called to tell you say segun don die.

Me: hahahaha, idiot. Na me you won catch April fool.

Mama T was eating her food slowly while she was watching me keenly.

Ayo: no i swear, forget say today na first of April but believe me, segun don die. him die yesterday.

Me: eyaa. I no surprise at all because me too i get something wey i want tell you.

Ayo: wetin be that?

Me: Buhari get twin brother. Na yesterday he see am.

Ayo: you dey mad, i dey tell you serious thing you dey there dey form stupidity ba.

Me: mtcheeew, abeg go find another person to catch April fool.

I said and cut the call angrily.

Mama T: whats the matter honey?

Me: can you imagine, Ayo my friend just called telling me that segun is dead.

Mama T: *rolled her eyes feeling uneasy* i guess he has come with his joke again, abeg lets eat.

We ate the food and went to the cashier’s office to pay when mama T quickly doubled crossed me and paid for the food.

Haba, no problem. Na those kind things i dey like i swear.

We walked back to my car and drove back to our office.

Tobi: *entered my office* abeg tell me the way wey you take dey do am.

Me: *looking surprised* do wetin?

Tobi: the way wey you dey make all the boss dey like

Me: hahaha *relaxed in my chair* its very easy?

Tobi: how?
Me: be handsome as me, tall as me and intelligent as me..

Tobi: hahaha, abeg no vex but you know say you carry F9 for everything wey you talk now?

Me: see this stupid idiot oo, you wey carry A1 how many people don like you.

Tobi: ahhhhh, many if you no know.

Me: abeg commot make i work jare.

Tobi: no problem but one day, this things wey you dey do go back fire.

Me: go back fire for which person head.

Tobi: idiot, na my head e go backfire because na me dey do them abi?

Me: amen oo, e go backfire for your head seven folds.

Tobi: chaii, God help you…

Share On Social Media

Meet The Blogger

CarlosOla verified
INCHARGE OF: Story Time
🏅 Admin @ Soundreloaded.net
Click To View Post By
RECOMMENDED SONGS
No Comments Yet Drop Comment

Leave a Reply

NOTE-: Comment Will Appear After It Has Been Approved By Admin (Less Than 1Mins).

|

Soundreloaded Music Banner Advert